An open letter to God.

in blurtafrica •  2 years ago 

Dear God,
Is me writing again,
Yes I know we spoke yesterday.
But I still feel the need to pour out my mind.
Else I might end up losing my mind.

Dear God,
Remember say you been promise me daily bread,
No be say I no dey bend,
Yet hunger just tie me like dread
And my eyes just dey red.

Screenshot_20220721-120431.jpg

Dear God,
The way my enemies dey prey
E come be like say I no dey pray
Even when you know say na me and you dun dey tey tey.
Suffer head dun make me fail.

Dear God
How I wan take go see my mama?
After all the whole prayers wey she dun pour for my matter
Wetin do that Bentley wey I promise her.
Abeg no make me dey hide when my friends dey bam.

Screenshot_20220418-175652.jpg

Dear God,
Condition dem talk dun make crayfish bend,
Even my babe dun kukuma leave me with my suffer head
Abi na like this you want make I end?
Abeg reply me, Na you be my last hope for the bread.

Dedicated to every hustler out there, one day you will hustle will pay off 🙏🙏🙏

Authors get paid when people like you upvote their post.
If you enjoyed what you read here, create your account today and start earning FREE BLURT!
Sort Order:  

Congratulations, your post has been curated by @techclub


Manually curated by

@chibuzorwisdom

c362c2cf8c19fc34a19e29e5a2db7acb60e3b4b3 (1).jpg

Follow techclub DISCORD for more updates and use tag #techclub for tagging content

you can also delegate to @techclub to support curation

OBRA MAESTRA


Posted from https://blurtlatam.com

Great Work 🤬🥓

onefollower


Posted from https://blurtlatam.com